BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
Who be di 28 governorship candidates of opposition ADC for 2027 elections
Di party wey be like di main opposition for Nigeria now get ogbonge pipo like former Attorney General of Nigeria, Abubakar Malami and former Lagos State govnoeship candidate for Labour Party Rhodes Vivour as dia candidates.
March and March protesters clash wit foreign nationals for South Africa, pipo injure
Na officer of di South African Police Service try stop di figh afta some members of March and March movement sustain injury
Wetin be Nigeria relationship wit Niger as Tinubu govment deny say dem back failed coup
Nigeria describe di claims as baseless, irresponsible and a deliberate attempt to misinform di public and tarnish Nigeria image.
Niger army see plenty weapons for Base 101 wia mutiny happun, wetin go happun to di sojas afta di coup attempt wey fail
Niger army don come out to say make officers and soldiers wey go missing from dia positions during di mutiny to return to service.
Wetin we know about death of 30 suspected oil vandals for Rivers State
Tori be say di pipo bin dey load di crude oil wey dem tiff wen di incident happun.
Suspected bandits threaten Sokoto community wit attack, demand $30,000 to withdraw
Residents of Kebbe town for Kebbe Local Government Area of Sokoto State Northern Nigeria report say dem dey face fresh security wahala.
House of Reps panel clear Gbajabiamila afta investigation on 'fake agency' PFIPC
For dia preliminary report, di committee say dem no find evidence say Gbajabiamila authorise, establish or participate for di activities of di fake agency.
Why Atiku dey raise anoda certificate forgery accuse against Tinubu for court?
President Tinubu bin face similar certificate forgery accuse for di 2023 election period ova im Chicago University degree, but court later throw di mata comot.
Iran attack US targets for Middle East afta four pipo reportedly kpai for wedding celebration
Kuwait and Jordan say dem dey respond to Iranian attacks early on Wednesday, while Iranian state media report strikes on Iraq and Bahrain.
Special Tori
Deadi bodi of Uganda youngest king wey die at 34 land from US for burial
Family, friends and govment officials receive di deadi bodi of di 34-year-old king wey arrive for Entebbe Airport on Friday, 4 September.
Uber, GSK, ShopRite and oda foreign companies wey don comot for Nigeria - why dem dey leave?
Hia na list of ten companies wey don comot for Nigeria in di past five years.
Senator Sharafadeen Alli campaign organisation react to viral video of govnorship candidate wit students wey dey make Nigerians tok
For inside one viral video, Senator Sharafadeen Alli, wey currently dey represent Oyo South Senatorial District for di National Assembly, carry one student for leg during one interview.
'We make difficult decision’ - Uber tok why dem shutdown operations for Nigeria
Uber say na very difficult decision for dem to comot from Nigeria but dem gatz do am sake of dia 'business priorities'.
OPay wey millions of Nigerians dey use respond to fake news say dem dey shut down for Nigeria
Chief Operating Officer of di company Dotun Daniel Adekunle tell tori pipo on Wednesday say di tori wey dey trend na fake news by haters.
Why US troops dey comot for Nigeria and wetin e mean for fight against insecurity?
Nigerian authorities don confam di planned withdrawal, say e no mean say security ties between Abuja and Washington don weak.
Four pipo land for court afta dem stab baby 15 times till death
For di hearing on Tuesday dem tell court say dem find di baby deadibody on top of washing machine for di outhouse and dem bin wrap am inside towel inside one blue bag.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.
