Family of Nigerian flag designer tok why dem neva bury dia papa

Pa Michael Taiwo Akinkunmi wey design Nigerian flag don die at di age of 87

Wia dis foto come from, Akinkunmi Akinwumi Samuel/Facebook

Wetin we call dis foto, Na Pa Michael Taiwo Akinkunmi design di Nigerian flag as di kontri dey get im independence

Di family of di man wey design di Nigeria flag say dem still dey wait for goment to choose date for dia papa burial.

Pa Michael Taiwo Akinkunmi die 29 August, 2023 at di age of 87.

Im family explain why dem neva bury di late Nigerian Icon inside statement wey dem release.

According to di family, dem say di committee wey goment set up to plan im burial "dey take till thy kingdom come".

"If goment no dey interested to give our national Icon, Michael Taiwo Akinkunmi (OFR) a befitting burial as dem promise, make dem allow di family do am di little way dem fit through di help of God and well-meaning individual," Akinkunmi Akinwumi Samuel tok.

Di family also share say dem bin plan im burial for 7th and 8th December 2023 but di Oyo State goment cancel am sake of say none of di state official bin dey present wen dem pick di date.

But dem add say dem no wan drag goment on top dis mata or make am look like say dem get any entitlement mentality.

Na im make dem bring di mata come outside so everybodi go know wetin dey happun.

“Life indeed dey short; I fit tok wit my full chest say you live life wit landmark. Continue to rest, my papa! Pa Michael Taiwo Akinwunmi (O.F.R). Great Man don go,” Samuel tok as im pay tribute to im papa.

Who be Taiwo Akinkunmi?

Michael Taiwo Akinkunmi wey design Nigerian flag don die at di age of 87

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Nigerian flag

Michael Taiwo Akinkunmi na one correct Nigeria civil servant wey bin design Nigeria flag as di kontri dey prepare for independence from Britain for 1960.

For 2014, Nigeria former president, Goodluck Jonathan, give am national honour, Order of di Federal Republic (OFR).

Dem born am for May 10 1936 and im come from Owu, Abeokuta, di Ogun State capital, southwest Nigeria.

For im primary school education, Taiwo attend Baptist Day Secondary School for Ibadan, di Oyo State capital, southwest Nigeria.

Taiwo attend Ibadan Grammar School for im secondary education.

Im work as civil servant for di secretariat for Ibadan.

Later im travel go London to study Agricultural Engineering for Norwood Technical College.

Na wen im dey study for London, im see advertisement for newspaper wey call for submission of designs for Nigerian flag.

Im submit im own design and dem select am as di best among more dan 2000 entries. Dem compensate di 23-year-old Taiwo wit £100 for di design.

Afta im graduation from Norwood Technical College, Taiwo return to Nigeria and work for di Ministry of Agriculture.