Karim Adeyemi: Biography of RB Salzburg player wey dey linked to Liverpool
Wia dis foto come from, Getty Images
RB Salzburg player Karim Adeyemi, name full pipo mouth afta im Champions League performance on Wednesday.
Adeyemi bin score two goals to help im team beat LOSC 2-1 for dia second group G match.
Many pipo don dey link am wit move to English club, Liverpool.
Dis na eviritin you need to know about di striker.
Who be Karim Adeyemi?
- Full Name: Karim-David Adeyemi
- Age: 19
- Height: 1.80 m (5 ft 11 in)
- Nationality: German
- Current Team: RB Salzburg
- Position: Striker
- Preferred Foot: Left
Wia dis foto come from, Getty Images
Karim Adeyemi na 19 year old German born striker wey dey currently play for RB Salzburg for Austrian Bundesliga.
End of Di one wey oda users dey read well well
Adeyemi bin start im professional career for SpVgg Unterhaching wia im rise from di youth system to eventually play for di U19 Bundesliga side.
Afta im shine well-well, Austrian side RB Salzburg decide to sign am for a three-year deal.
As soon as Adeyemi bin sign for Salzburg, im go on loan to dia 'feeder' club FC Liefering.
Adeyemi bin shine well-well during im time for Liefering and sharpaly RB Salzburg call am back to di team.
Afta dem lose di likes of Erling Haaland and Takumi Minamino, Salzburg begin dey rely on Adeyemi a lot to help dia attack.
Im first full season for di Austrian Bundesliga for 2020/21 bin dey very impressive and na dia wey world scouts really start to notice am.
Adeyemi bin play 29 games for di Bundesliga for Salzburg and score seven goals and seven assists wey help Salzburg to win dia League title.
For dis 2021/22 season tins dey even better for am, e don score six goals for di opening six games for Salzburg
Already sef German national team coach Hansi Flick don invite am to di national team.
Adeyemi bin come on for di 71st minute against Armenia and even score sef for im debut.